AFCON 2015: Security for Afcon final go tight well well Confederation of Africa Football (Caf) don order say make dem increase security level for de Africa Cup Nations final wey go shele for Sunday between Ivory Coast and Ghana for Bata. “We don call for more Ekelebe and for security to dey kampe”, naso Junior Binyam wey be Caf media director yarn for Friday. “We wan plenty Ekelebe to full ground gidigba and for we to get de confido say our spectators go dey safe”. Na afta de katakata wey shele for Thursday semifinal for Malabo wia 36 pipu bin get injury and one get serious woud dat dem kon make de request. De game wey shele between de hosts and Ghana wey win 3-kondo bin stopped for more dan 30 minites for de secon-haf wen de game don dey finish wen dem begin throw things inside de pitch from de stands against Ghana teams, officials and fans by de local supporters wey dey vex sake Ghana bulala dia team. Dem kon increase security for de stadium as de organisers kon dey fill de 35 000 capacity stadium to make pipu feel betta for de championship final. De number of pipu wey enta Equatorial Guinea for de Nations Cup dis year betta and big pass other years. SOURCE: © supersport.com